Advertisement
Advertisement

Hilarious Nigerian Pidgin Proverbs for Family and Friends

Abeg share this better Hilarious Nigerian Proverbs for Family and Friends with the people wey dey give you joy.

 

It is time to tell it as e be in a funny and hilarious Naija way. These Nigerian pidgin proverbs na wetin go give you joy and make you laugh till you forget your sorrow. 

Make you take time to send these better Naija proverbs to your friends and family members. If you send am to your enemy, that one fit make am become your friend too. 

If you like better things, you go like to laugh and forget some problems of this life as you read these hilarious and funny Nigerian proverbs. Make you no inherit another man enemy for the sake of loyalty, that one na stupidity of the highest order. Abeg shares this better Nigerian Hilarious  Proverbs for Family and Friends with the people wey dey give you joy. If you share am with your wicked landlord, e fit take style reduce your house rent. 

Hilarious Nigerian Pidgin Proverbs

E sweet me e sweet me na so dumebi take carry bele. This one shocked you. Na wetin dey sweet man, na the same dey bring am wahala. Motivational Poems about Success 

[1]. One day e go beta na im make camel still de carry load.

[2]. I mean, just a friend, na so belly use shot out.

[3]. Na me dey rule the night, na me dey rule the night, na im moon take turn watch night.

[4]. Sweet gist to sweet gist, na so okada man use get wife ooo.

[5]. Thanks so much e no means say make you no do another one ooo.

[6]. Anybody way want RUGA don tire for this life.

[7]. Dog wey dey raise leg pees still get babes to impress.

[8]. kola nut only last in the mouth of those that value it.

[9]. Who drink nor dey lead for war.

[10]. Any mouth wen e talk any how na ear dey suffer am.

Hilarious Wise Sayings of Nigerian Elders

Monkey say him real name na Michael na people wey no like am dey call am Monkey. Make you no choke for this one o. Them say if you no like dog, you suppose like am for the way wey e dey take to sit down. Words of Motivation about Joy

[11]. I will think about it na so dem take dey eat boys money.

[12]. Baby am coming, am coming na so relationship start to dey end.

[13]. A cooking pot for Lizard is a cooking for Carmel leon.

[14]. No condition is permanent no make am say make you fold hand sidon look.

[15]. Do you know who I am? Do you know who I am? Na so hold up take dey start.

[16]. Say cat sabi swim no make am catfish.

[17]. Who follow you measure house no go follow you mould blocks.

[18]. I wan celebrate new yam festival for abroad na im make somebody chop slap without cutlery.

[19]. Fly can escort the curps, but it can never enter the grave with the curps.

[20]. Who sit down for ground no dey get up for person to sit down ooo.

Hilarious Words of Nigerian Elders

E dey clear pimple, e dey clear pimple, naso bleaching dey take start. No be everything wey you hear e dey work go actually work. Make you learn to be contented with the way wey them take create you. Birthday Messages for Man of God

[21]. Na only Papa dey carry em Pikin throw up and catch am back but if Pikin carry em Papa wan throw for up na im Papa long leg dey slap em face.

[22]. Person wey get brother for heaven no dey go hell fire.

[23]. Our destiny can only delay, it can't change. 

[24]. No be as beans sweet em shit dey small.

[25]. Abeg eye wen dey cry dey see road.

[26]. Fine girl way too waste time na old man go marry am when menopause near.

[27]. No be say person get big head make dem dey call am headmaster.

[28]. Monkey nor fine but e mama like am.

[29]. Pot wey go chop pepper em bumbum go red for fire.

[30]. To sit down dey hungry Lizard but na him tail no gree. 

Funny Proverbs in Nigerian Pidgin

Wetin concerns dog with family planning. Seriously as human, we suppose plan. Make you no bring pikin come this world wey you never ready to train. This one na funny but reality proverbs wey go make you laugh and also think. Words of Encouragement about Faith

[31]. Lizard wey him tail don cut the make friend with Toad.

[32]. Na bad condition make crayfish bend.

[33]. No matter how talk plenty reach, ear will never get filled.

[34]. I will do I will do na him make carpenter no get chair for house.

[35]. No matter how person head big e no fit contains 3 bedroom flats ooo.

[36]. Say Lion dey sick no mean say him and Cat na mate.

[37]. No matter how Lizard do press up reach e no fit get muscles reach Crocodile.

[38]. Bird wey no say dey go use e feather clean ear no go fly near ground ooo.

[39]. He no fit satisfied me for bed na he make oyibo woman dey marry dog.

[40]. Cut kpomo, cut beef all na for cow body.

Funny Nigerian Proverbs in Pidgin Language

Motor full motor full e nor mean say e nor go contain driver. Anyway, this one na food for thought. If motor full and no space for driver, abeg na who go suffer am? Love Messages for Him or Her

[41]. The death of a lion can not be announce by a goat.

[42]. Chelsea for life, Chelsea for life, na him make Manchester United beat them 4:0.

[43]. Because fish and shark dey the same river nor mean say dem be age mate ooo.

[44]. No bi today yash begin get center parti, e don tee.

[45]. No be as pikin de play for im Mama breast im go go play for in Papa blokos.

[46]. To give Monkey water no be the problem but na to collect the cup.

[47]. Base on logistics na e million take day come fast guy account.

[48]. Mushroom wey take corner corner grow, you go use corner corner remove am.

[49]. Because I dey find woman, no mean say I go marry pregnant woman.

[50]. No matta how seriously Hyena dey sick, dog no de branch ask am how body?

Nigerian Funny Proverbs in Pidgin

Na stubborn fly da follow dead body enter grave. There is nothing good in stubbornness. It is good to be humble and also hear word. If you are asked not to do a thing, consider the words of advice. Na pikin wey hear advice dey live long o. Christian Birthday Wishes for Mother

[51]. I go make am, I go make am before a year, na him make Yahoo boy's dey used women pants dey do juju.

[52]. Frog like water but no be when water hot.

[53]. Over confident na hem make agboro go March sojaoooo,

[54]. An old woman once said, the erection of blockos no the fear her again, meaning no be today person being to see things.

[55]. Just a tenure, just a tenure, no be for 9ja politicians ooo.

[56]. Dis election must be free and fair election, my brother not bcus of Nigeria ooo.

[57]. Who say Vulture nor go enter market go soon comot market for vulture.

[58]. Flies were no dey get advicer e dey follow coffin peme for inside grave.

[59]. The young shall grow, no be for dwarf.

[60]. This suya sweet this suya sweet, na cow body de suffer am.

Funny Pidgin Proverbs in Pidgin English

Na my boss na my boss before you close eyes open you don dey miss your period. Too much familiarity dey bring insult. Make you know when to draw the line in everything you do. Relationship Advice for Single and Married

[61]. Na big eye na im make horse no get horn.

[62]. No food for lazy man no be for person wey im Mama get restaurant.

[63]. Pikin wey dey call him Mama boyfriend brother, nor be say he nor know wetin he dey do na because of that small, small things way he dey get from that man dey make him dey call am brother o.

[64]. Dem no dey do naming ceremony for pikin way dey inside belly.

[65]. By force, by force de cause chest pain.

[66]. I no gree na im dey tear shirt.

[67]. Pikin wey say im Mama no go sleep, how imself go take sleep?

[68]. I get money, I get money nor mean you go use one bag of salt make soup ooo.
 
[69]. Two neighbours way go work the same time and one first one close for work make he know say him wife na suspect.

[70]. Use your head before men help you use am.

Hilarious Proverbs in Pidgin Language

Na for Naija person go recount the money wey ATM pay before e go, go. Men wey no trust himself no fit trust anybody. I sure say this one go make you laugh wella. Relationship Advice to Make a Man Happy

[71]. Until a Crab enters into a hot water, it will never believe there are two types of water on earth.

[72]. Pikin wey dem carry for back no know sey journey far ooo.

[73]. Prince wey no know himself na im dey beg im Papa for chieftaincy title.

[74]. Monkey wey dey look into hunter face, will one day collect bullet for e forehead.

[75]. Woman dey run hold breast, no mean say the breast wan fall.

[76]. Fawol wen dey sleep on top of tree no means say na there e go lay egg.

[77]. Wetin concern Airoplane say the bridge don cut.

[78]. Nothing dey disarm a man like tse-tse fly wey perch for him manhood.

[79]. Them no dey tell deaf man say war don start.

[80]. Na mind and strong eye dem take dey drive shit motor.


Better Hilarious Nigerian Proverbs in Pidgin

If e better for Pussy cat e go say e wan drink tea. Man wey holds money no dey hide. If you have it, sure it can't be hidden. Make you laugh and if not, something dey wrong. Birthday Messages for Loved Ones

[81]. Kolanut last long in the mouth of those who knows its value.

[82]. Ashawo way em house dey burn em from window run no loose because em carry em business run.

[83]. I wan grow up no mean say you go do high jump.

[84]. Speed dey sweet o but wen you fall you go gada crowd.

[85]. Wen nikka dey tear, e go dey turn trouser.

[86]. I dey bold, I dey bold, na e make cobra kill and swallow rabbit for inside hole.

[87]. Make I just make up, na e people face take fair pass yanch.

[88]. Pesin wen dey scratch e private part for sleep must wake up wit smelling fingers.

[89]. Dis pass you talk, anoda one pass you talk, na e pesin take become aproko.

[90]. No mata how food sweet, e must turn shit for bele.

Sample Funny Nigerian Proverbs

Na if you see Iyawo face you go ask am wetin e born. Them say the face na the in-depth of the heart. Let your appearances always speak good of you. Naija Romantic Love Pidgin Poems

[91]. Love no get eye if not, tongue for no lick dirty teeth say na kiss.

[92]. Pesin wen too dey check dirty go soon see shit.

[93]. Make I teach you how dem dey do am na e crocodile dey kill dog mother for water.

[94]. Follow, follow go smell mess.

[95]. Nothing go for nothing.

[96]. You are too good, you too good no mean say make you dey rase shoulder ohh.

[97]. Pikin wey no know e Mama boyfriend dey call am Uncle.

[98]. You never see problem na e make you dey use English and Pidgin dey pray nobodi go tell you before you go switch to your local dialect.

[99]. I sabi climb tree, now live me alone, na him meki goat no sabi climb tree tele now.

[100]. I know am pass you I know am pass you na so oversabi take start.

COMMENTS

Advertisement
Advertisement
Advertisement
Advertisement
Name

About,4,Advertisement,15,Affiliates,9,Automobile,6,Blog,155,Bookshop,12,Bulletin,13,Contact,4,Dairy,8,Disclaimer,1,Domain,5,Electronics,9,Faforlife,5,Finance,46,Forever,2,Inspiration,42,Insurance,15,Logo,8,Medical,17,Messages,18,Motivation,12,Pidgin,6,Poems,3,Poetry,39,Prayer,20,Privacy,4,Proverb,17,Quotes,5,Relationship,30,Scholarship,27,Shopping,10,Sitemap,1,Software,5,Straightway,30,Thoughtfulness,4,Tourism,28,Videos,35,
ltr
item
Nsikak Andrew – In Patches of Thoughts, Words are Formed!: Hilarious Nigerian Pidgin Proverbs for Family and Friends
Hilarious Nigerian Pidgin Proverbs for Family and Friends
Abeg share this better Hilarious Nigerian Proverbs for Family and Friends with the people wey dey give you joy.
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEiiaM7kHok3Z0dVfuqKynMUPYp9uMtFN6ZjSdH25_BbM_n10WO2Ph_W8QhWkRFJoljiWUHR0oJSBIplciemOIMt0MUvnl3L5ZH9ALw-f0hcvpu5DwJHEBfiK7H3q5SYGZi7XNsKA7Y0_IBu/w640-h434/funny-proverb.jpg
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEiiaM7kHok3Z0dVfuqKynMUPYp9uMtFN6ZjSdH25_BbM_n10WO2Ph_W8QhWkRFJoljiWUHR0oJSBIplciemOIMt0MUvnl3L5ZH9ALw-f0hcvpu5DwJHEBfiK7H3q5SYGZi7XNsKA7Y0_IBu/s72-w640-c-h434/funny-proverb.jpg
Nsikak Andrew – In Patches of Thoughts, Words are Formed!
https://www.nsikakandrew.com/2021/04/hilarious-nigerian-proverbs-for-friends.html
https://www.nsikakandrew.com/
https://www.nsikakandrew.com/
https://www.nsikakandrew.com/2021/04/hilarious-nigerian-proverbs-for-friends.html
true
6735574273814631375
UTF-8
Loaded All Posts Not found any posts VIEW ALL Readmore Reply Cancel reply Delete By Home PAGES POSTS View All RECOMMENDED FOR YOU LABEL ARCHIVE SEARCH ALL POSTS Not found any post match with your request Back Home Sunday Monday Tuesday Wednesday Thursday Friday Saturday Sun Mon Tue Wed Thu Fri Sat January February March April May June July August September October November December Jan Feb Mar Apr May Jun Jul Aug Sep Oct Nov Dec just now 1 minute ago $$1$$ minutes ago 1 hour ago $$1$$ hours ago Yesterday $$1$$ days ago $$1$$ weeks ago more than 5 weeks ago Followers Follow THIS PREMIUM CONTENT IS LOCKED STEP 1: Share to a social network STEP 2: Click the link on your social network Copy All Code Select All Code All codes were copied to your clipboard Can not copy the codes / texts, please press [CTRL]+[C] (or CMD+C with Mac) to copy Table of Content